Anti-migrant protesters say June 30 deadline for migrants to comot for South Africa still stand.
Leaders of di anti-migrant movements and some civic society groups wey include di March and March tok say di 30 June deadline for undocumented foreign nationals to leave South Africa no dey change.
For one news conference on Wednesday, 24 June ahead of di deadline, Jacinta Ngobese-Zuma, leader of di March and March movement clear am say no be dem choose di date, but na South Africans wey wan see di kontri take shape.
Ngobese-Zuma also clear am say dem no dey plan to shutdown di kontri for dat day, and dia target no be only black foreigners, but any foreign nationals wey dey live for dia kontri illegally.
As she dey ansa questions from tori pipo on wetin go happun on di day, di March and March movement leader say di demonstration dey expected to dey peaceful, as she reject accusations say di protest dey promote violence against foreigners.
Ngobese-Zuma plus oda representatives from di several civil organisations repeat am say di demonstration na to put pressure on di govment to compulsory immigration laws, secure di borders and address wetin organisers describe as illegal immigration crisis.
"Di 30 June deadline no eva dey about violence. E no eva dey about shutting down di kontri. E no eva dey about harming anybodi. All we dey ask na for illegal immigrants to leave our kontri and for govment to enforce di laws wey already dey exist," she tok.
Di 30 June deadline don bicom rallying point for several civil organisations wey don align demsefs wit March and March campaign against illegal migration.
Organisers say communities across di kontri and South Africans abroad dey in support of di initiative, becos dem believe say di govment don fail to respond to dia concerns about porous borders plus di pressure on public amenities and high unemployment for di kontri.
As fears dey say di protest fit escalate and trigger tension, Ngobese-Zuma maintain say organisers dey committed to peaceful action and condemn pipo wey dey criticise dia intention.
Di South Africa minister of police bin meet wit oda national commissioner as part of dia preparation for di protests on Monday.
Local media DailyMaverick bin quote wia di police minister say South Africans get di constitutional rights to protest, but no go allow any act of lawlessness or violence.
"Di aim of di operations na to make sure say all foreign nationals wey dey stay for South Africa fit stay for di kontri legally and get valid documentation."
South Africa Minister of Justice Mmamoloko Nkhensani Kubayi dey monitor di evacuation of some foreign nationals.
Di justice minister dey part of di Inter-Ministerial Committee (IMC) on Migration, and dem dey monitor how some migrants comot for South Africa by buses.
Dem also visit di king of KwaZulu, King Misuzulu kaZwelithini, for di Royal House wia dem go tok how govment dey make efforts to manage migration for di kontri.
Di acting Minister of Police, Cachalia bin dey do meeting wit Defence Minister, Motshekga ontop dis June 30 demonstrations, but di outcome of di meeting neva dey public.
Meanwhile, dem say na closed door meeting and media no go fit capture wetin dey happun inside, but na until afta di meeting di minister go tok.
Credit: NEWS PIDGIN
BBC