Vice President of Equatorial Guinea, Teodoro Mangue, don tok say dem go begin install camera for offices of all state officials.
Dis dey come afta alleged viral sex tapes of di former head of di kontri anti-graft National Agency for Financial Investigation (ANIF), Baltasar Ebang Engonga, bin go viral on social media.
E add say any pesin wey dem catch engaging in sexual relation for offices go face di consequences.
"Di goment go soon implement di installation of surveillance cameras in all offices of State bodies.
"We don make dis provision to ensure compliance with di law by officials and to eradicate unseemly and unlawful behavior.
"We no go admit any misconduct wey go denigrates di integrity of our administration and pipo wey engage in such practices go face drastic measures,” di vice president tok.
Credit: BBC News Pidgin
Read more on dis tori for here: https://www.bbc.com/pidgin/articles/czd5y25gdezo