Nigerians on social media dey mourn di death of Salome Adaidu wey her boyfriend allegedly behead for Nasarawa State, north-central Nigeria.
Police for Abuja bin clarify in reaction to di tori say na Nasarawa e happun
Dem allegedly gbab Timileyin Ajayi wey be gospel singer wit Adaidu head on Sunday 12 January near one church for Orozo.
"Salome Adaidu, your killer no go eva go unpunished and may your gentle soul rest in peace," one of Adaidu friends tok for Facebook.
Credit: BBC News Pidgin
Click here to read more on dis tori: https://www.bbc.com/pidgin/articles/cx24nddv4v4o
Federal High Court for Abuja don grant order of interim injunction wey go stop human rights activist Dele Farotimi from further publishing, selling, circulating, advertising, or distributing di physical/hard/digital or soft copies of di book: “Nigeria and Its Criminal Justice System”.
Justice Peter Kekemeke grant di order on Wednesday, and add direct security agencies for di kontri to stop di publication, selling and distribution of di book.
E say make security agencies to comply wit dis directive within 72 hours.
Di judge grant di order afta im listen to di exparte application wey di claimant, di managing partner at Afe Babalola law firm, Kehinde Ogunwumiju, bin file.
Credit: BBC News Pidgin
Facebook
Dear Northern Governors,
Go for farms and factories, not airports and dry-land bridges. The stakes are much higher than absolute personal interest.
Passed or not, the Tax Reform Bill has opened a pandora box of structural deficiencies and economic inadequacies that must be addressed with the greatest sense of urgency.
The consequences of not wearing an authentic, high performance and value driven thinking cap is unimaginable at this stage.
I hope this is not too late.
Mallam.Adamu.Garba II
Credit: TVC NEWS NIGERIA
Borno State Govnor, Professor Babagana Zulum, don tok say na only Lagos and Rivers State go benefit from President Bola Tinubu tax reform bills.
Governor Zulum wey yarn dis one for Channels Television Sunday Politics explain say na research and calculations by northern govnors make dem get dat position.
“For dis tax mata, plenty pipo no understand wetin dey. We look di VAT provision for di tax law. From di calculations wey we do, na only Lagos and Rivers go gain from di plan. We do our own research, we come see say we go lose,” Zulum tok.
“Why we dey rush? We advise federal goment make dem pause and remove some parts wey no go favour Northern Nigeria.”
Credit: BBC News Pidgin
Facebook
Follow Follow
Delete Comment
Are you sure that you want to delete this comment ?
Follow Follow
Delete Comment
Are you sure that you want to delete this comment ?