Hakeem Baba-Ahmed, former special adviser to President Bola Tinubu, don strongly criticised di late former President of Nigeria Muhammadu Buhari who dem bury on Tuesday.

For interview wit di BBC, Baba-Ahmed, wey also be former tok-tok pesin of di Northern Elders Forum say, “History no go judge Buhari as one of our greatest President" sake of im failure for governance.

"Di verdict of history about him no go dey favourable to him," Baba-Ahmed tok.

E accuse say Buhari bin enable corruption and allow insecurity to deepen.

Baba-Ahmed also claimed say Buhari bin appear detached from im administration and e lack genuine integrity.

According to am, Buhari wey bin get wide support for di north, later lose public trust by di end of im tenure.

Credit: BBC News Pidgin
Facebook

image