Nigeria goment wan spend N8 billion take educate Nigerians to pay dia electricity bills on time for 2025.

Na so di Minister of Power, Adebayo Adelabu, tok as im bin dey defend im ministry budget for National Assembly joint committee on power yesterday.

Oga Adelabu, say many Nigerians need anoda education again on why dem need to pay NEPA bill on time.

Di education campaign wey di ministry plan to do for social, digital and newspaper, na to remind di kontri pipo say di electricity assets na national assets, and everybody suppose follow own am.

Credit: BBC News Pidgin
( Facebook)

image