Di Independent National Electoral Commission (Inec) don propose di sum of 126 billion naira for dia 2025 budget.
Professor Mahmood Yakubu wey be di chairman of di Commission make di presentation wen im bin defend di 2024 budget implementation bifor di National Assembly on Friday.
“Our proposal for 2025; di Commission require di sum of 126 billion naira. So, we go like di support of di National Assembly members to ensure say we dey adequately funded for di responsibilities we dey required to discharge, and most of dis responsibilities dey constitutional, dem no just dey di Electoral Act,” Prof Yakubu tok.
Prof Yakubu also express concerns over di high cost of conducting elections for Nigeria.
Credit: BBC News Pidgin