President Bola Tinubu dey travel go Europe to begin im three-week vacation as part of im annual leave.
Tok-tok pesin to di President Bayo Onanuga announce di informate for one post on X on Sunday, 30 August.
Onanuga say di Nigerian leader go comot Abuja today, and im first stop go be for London, UK.
“President Tinubu dey expected to return home afta di working vacation to join di hectic campaign for di January 2027 election,” Onanuga add.
Credit: BBC News Pidgin
facebook