Rivers state Govnor Siminalayi Fubara don reply say im no dey worry about di court judgement wey dey prevent am from accessing money from federation account.

Govnor Fubara say na least of problem wey Rivers state pipo get be dat.

Di govnor react during di special thanksgiving service wey di state organise to celebrate how dem survive attack for di state House of Assembly complex one year ago.

“Dem say we no go last one week, but we dey here one year afta wey dem attempt to take our lives. Dem say di local govment chairmen no go live but today dem dey wit us.

"No worry about di tori for social media, na di least of your trouble," di govnor tok.

Govnor Fubara say peace go reign for Rivers state and not like odas wey no dey behave like ‘honourable’.

Dis reaction dey come afta one Federal High court for Abuja say make Central Bank of Nigeria (CBN) no release monthly allocations to Rivers state goment.

But Govnor Fubara say im go still pay contractors and salary go reach all di workers for di state.

“We no dey here to steal your money, we don pay salary and by tomorrow your salary go reach you,” Fubara tok.

Read more on dis tori for here: https://www.bbc.com/pidgin/articles/clyvel7kwgvo

Credit: BBC News Pidgin
Facebook

image