Former presidential candidate, Peter Obi, don blame di hustle to survive for dis kain sapa period as di reason behind di deaths of plenti pipo for stampede wey happun for Ibadan, Abuja and Anambra.
At least, ova forty pipo don die around Nigeria in di last week on top stampede mata wey happun for three separate parts of di kontri.
On Wednesday, 35 pikin dem die for stampede for one funfair wey bin dey happun for Ibadan, Oyo state capital for di south west of Nigeria.
On Saturday, authorities for Abuja confam say at least ten pipo wey include four pikin bin die for stampede for catholic church wen dem dey distribute food items to poor pipo.
For di southeast of di kontri, on di same Saturday, anoda stampede also claim lives for Anambra.
Ontop im X page, Obi say wetin happun for Ibadan, Abuja and Anambra reflect di systemic failure wey dey di Nigerian society.
Di former govnor say how kontri pipo go take explain say for nation wey dey blessed wit abundant resources, Nigerians dey die of hunger in such numbers.
“How e dey possible say we no fit feed our citizens despite di vast, fertile lands our nation dey endowed wit? My heart bleed,” Obi tok.
Credit: BBC News Pidgin
Facebook