Former president of Nigeria, Goodluck Jonathan, don tell kontri pipo say dem no need to japa but instead, make dem invest in di kontri.
Jonathan yarn dis one at di weekend for Karu local goment area of Nasarawa State, north-central, during di commissioning of di Soybean Plant and Refinery of di CSS Group, and birthday celebration of Prof. John Kennedy Opara, former Executive Secretary of di Nigerian Christian Pilgrims Commission (NCPC).
“You no need to Japa. Na pipo build dose kontris you dey run to. We gatz build dis kontri togeda and invest in it so di youths fit get jobs.
“We must not run away from our responsibilities. Dis kontri belong to all of us, and we must not abandon am,” Jonathan tok.
Credit: BBC News Pidgin
Facebook

Proud Nigeria
supprimer les commentaires
Etes-vous sûr que vous voulez supprimer ce commentaire ?