Lagos police command tok say Nigeria singer, Habeeb Okikiola, wey pipo sabi as Portable, don surrender imsef.
Di singer carry imsef go give di state criminal investigation department for Yaba afta di Ogun State police command declare am wanted for allegedly assaulting dia officers.
Lagos police tok-tok pesin Benjamin Hundeyin say dem don call di Ogun State police command to come come carry di singer.
Create:BBC News Pidgin
Facebook
