US President Donald Trump tok say im go cancel Joe Biden security clearance and access to daily intelligence briefings, as im predecessor do di same to am four years ago.

"Need no dey for Joe Biden to continue dey receive access to classified information," Trump write for one post on im Truth Social platform.

"JOE, YOU DEY FIRED," Di Republican add for one reference to im catchphrase on di reality TV show, The Apprentice.

Trump don already cancel di security clearance of more dan four dozen former intelligence officials wey e accuse say dem interfere for di 2020 election in favour of Biden.

Trump bin post on Friday evening say na Biden "set dis precedent for 2021, wen e instruct di Intelligence Community (IC) to stop di 45th President of di United States (ME!) from accessing details on National Security, courtesy wey dem dey provide to former Presidents".

Credit: BBC News Pidgin
Facebook

image